NEWS | GHANA MUSIC | ALBUM/EP | Amapiano | South Africa Music | Throwback Music
FREE BEAT | GOSPEL MUSIC |


Join Our WhatsApp Group

  CLICK HERE TO PROMOTE YOUR SONG


Burna Boy
DJ NT
Wizkid
Naira Marley
Olamide
Tiwa Savage
Zinoleesky
Davido
Kizz Daniel
Omah Lay
Fireboy DML
Bella Shmurda
Runtown

« | »

ADA JESUS BIOGRAPHY: Who Is Ada Jesus

Posted by on April 26, 2021 1


News of The death of popular Nigerian comedian wey bin dey battle Kidney disease send shock waves into Nigerian social media space on Wednesday.

Di comedian bin dey limelight since di news of her sickness surface for February, 2021. Until di announcement of her death, most pipo no sabi much about di social media skit maker.

See some of di tins you fit no know about Ada Jesus?

Ada Jesus

Ada Jesus profile

Ada Jesus real name na Mercy Mmesoma Obi. She celebrate her birthday two days before dem announce her death on Wednesday.

Ada Jesus Mmesoma Mercy Obi

Di 23 year old Instagram sensation begin post comedy skits on social media in 2017. E no dey clear if dat na di year she start her comedy career but reports bin say before she start dey do skit, she bin perform as stand-up comedian and she perform for various events and shows.

Ada Jesus

But her comedy skit begin gather popularity sake of di reactions e get on social media. Most of her comedy videos dey in Igbo language, wia she address trending issues relating to celebrities and influencers. She don work alongside popular Nigerian comedians like Sir one, Kinemaster among others. Apart from comedy wey plenty pipo sabi Ada Jesus, she also be singer, she release one single wit comedian Emma Mbe for November 2020 wey dem title ‘Ada & Emma mbe in love’.

Ada Jesus

Ada Jesus

For one of her instagram post, Ada tok say she be mother. “Happy mother’s day to me, single or married ooo, I have a child, I be proud mother.” Na so she tok for di post. Ada Jesus instagram handle, @adajesuscomedy get over 30,0000 followers.

Source: DjNtLoaded.com

Drop your comments

572 views

Join Our WhatsApp Group

SEE RELATED POST



1 Comment Drop a Comment
  1. Anonymous - May 28, 2021 at 7:58 pm

    Reply

Drop your Comment




« | »

Looking for something? Search below