NEWS | GHANA MUSIC | ALBUM/EP | Amapiano | South Africa Music | Throwback Music
FREE BEAT | GOSPEL MUSIC |


Join Our WhatsApp Group

  CLICK HERE TO PROMOTE YOUR SONG


Burna Boy
DJ NT
Wizkid
Naira Marley
Olamide
Tiwa Savage
Zinoleesky
Davido
Kizz Daniel
Omah Lay
Fireboy DML
Bella Shmurda
Runtown

« | »

Ginimbi Genius Kadungure: Ginimbi death for accident as e celebrate Moana inside Zimbabwe traffic collision and more

Posted by on November 13, 2020 0


Ginimbi Genius Kadungure, die for accident early hours of Sunday morning inside Borrowdale, Harare, Zimbabwe.

Ginimbi na popular Zimbabwean socialite and millionaire until im death for road accident. Di 36-year-old bin dey drive inside e Rolls-Royce Wraith wen e collide wit three other vehicles, according to Zimbabwe police. Im bin dey celebrate fitness trainer Michelle Moana Amuli birthday wen di accident happun. Tori be say three oda pipo burn inside di vehicle as e later catch fire but some unidentified men bin remove Ginimbi body before di motor burn.

Ginimbi Genius Kadungure

Interesting facts to sabi about [Ginimbi Genius Kadungure] “Ginimbi”

If you be Nigerian and you no sabi Ginimbi, just take am say until im death, dis Zimbabwean socialite bin dey enjoy life like Nigeria Hushpuppi.

See oda interesting facts about am before im death.

Full name: Genius Kadungure

Nickname: Ginimbi

Year of birth: October 10, 1984

Age: 36 years as of 2020

Gender: Male

Career: Businessman – Chairman of Piko Trading Holdings & Founder of Genius Foundation, owner of Club Sankayi (AKA Dreams Nightlife Club).

Education: Master of Business Administration – MBA at Great Zimbabwe University

Base: Govan Mbeki, Mpumalanga, South Africa

Kontri of origin: Harare, Zimbabwe

Ginimbi Genius Kadungure

Ginimbi Background

Genius Kadungure na for Domboshava dem born am into family of four. E be Harare International Carnival ambassador. Kadungure start to do small business at di age of 17 as e become a middle-man wey dey help get gas for domestic users.

Ginimbi Net Worth

Ginimbi net worth alias money wey im don make bin no really dey known, as im business dem no dey listed publicly. Based on assets alias property wey im dey known to own, im worth fit reach be between USD $10 million and USD $100 million.

Ginimbi Genius Kadungure:

Ginimbi Fraud Allegations

In May 2014 Ginimbi Genius Kadungure bin chop arrest on allegations of fraud. E chop accuse say e defraud Zanu-PF MP for Chegutu West Dexter Nduna, di managing director of Badon Enterprises, and a Kadoma-based miner only identified as Gatawa of R1,581,890. (BBC Pidgin no fit confam how dat case don waka as at di timewe publish dis tori).

Between February 2009 and May 2016, Ginimbi Genius Kadungure chop accuse say im company Piko Trading (Private) Limited misrepresent to di Zimbabwe Revenue Authority say dem make total sales of $2 777 678 inclusive of value added tax wen in actual fact di company bin make more sales amounting to $9 092 951. In February 2018 Ginimbi Genius Kadungure dismissed claims say im owe R340 000 to South African based businessman Mutumwa Mawere. Di two bin get fall out and exchanged words ontop social media site Twitter after Mawere ask am Kadungure to pay back wetin im dey owe.

Ginimbi White Parties

Ginimbi Genius Kadungure dey known as di king of bling and for throwing lavish party dem. In 2010, im throw one expensive all-white birthday bash inside Harare, Zimbabwe capital wey become tok of town for Africa. Since then Ginimbi name and white parties na five and six.

Two years later, in 2012, Ginimbi host anoda extravagant birthday party, dis time inside Botswana. E no end dia.

In 2013, Ginimbi also throw a three-day long party for im village home inside Domboshava to celebrate a newly-built mansion wey im build for di area.

So on 10 October 2020 for di businessman and popular socialite Genius Ginimbi Kadungure birthday, im host a strictly by invitation all-white party and one sef be tori for town.

Unfortunate na from celebration wey Ginimbi like well e meet im end. Im bin dey return from party wey celebrate fitness trainer Moana birthday wen di dead car accident happun.

SOURCE: www.DjNtLoaded.com

562 views

Join Our WhatsApp Group



No Comments Yet Drop a Comment

Drop your Comment




« | »

Looking for something? Search below